My Freedom, I Dance, I Sad Poem by Gbolagade Taiwo

My Freedom, I Dance, I Sad

Jingoloba Goloba! !
Kerekeji! Kejikeke!
Match me I go
Freedom me I get
Hurray! Me I free
Shackles goeth off me neck
I don get freedom
My day I forget not
OctoBER don BERgain my freedom
Me I don own dis kingdom
If you no sabi my lines
Better you denounce your CARD
Na only me people fit dissect me lang.
Kereji! Ji kereji! !
Matcheth me I go
Freedom me I get
I don free from the Whites
But sad me I de for now
The Whites me I free
But the Blacks me I no sabi
Dem minds I no fit decipher
'Cos dem loot wide pass the Whites
Na today I de 'judibulate' me freedom
Watin de run me mind na dis kingdom
Me leaders no free my freedom
Dem just de change me 'food-dom'
Hunger de waya me
Water don cost for me place
Free I 'tink' divine giveth
Expenses don increase
Me people make we jam voice togeda
Make we no allow hunger go further
Bedspace don finish for cemetery
We no wan de increase for death
Freedom make we shout!
Whites don go away
Black we no fit remove,
But loot we fit comot
My lines have flaws
Judge me not for this
Na hunger de waya me
'Cos my freedom I dance, I sad.



Note: *Jingoloba* and *Kerekeji* are sounds of beat of freedom.
The language of the poem is intentional.


I wish you all happy independence and new month. May the tide turn for Nigeria
My land may be muddy, I cannot deny the blood runny in my veins, I love my land, I love NIGERIA

I am a Nigerian,
I am Gbolagade Taiwo Ayodeji.

Saturday, October 1, 2016
Topic(s) of this poem: independence
COMMENTS OF THE POEM
READ THIS POEM IN OTHER LANGUAGES
Close
Error Success