Na Doctor Dey Save Lives Poem by Okoemu Okoemu Okoemu

Na Doctor Dey Save Lives



Him no be God
But na God dey use am
Him dey care,
but na God dey heal
For physical mata,
Na Doctor dey save lives.
As I give my baby belle
Baby say she no ready be mother yet
Me man no ready be father yet,
Na wetin we go do?
Doctor wey dey save lives
Save our lives, abort the pregnancy
Him say, nothin dey dere
Na just foetus, abi no be the name be dat?
Well, him say na only blood,
E never become pikin!
Ahhh ahhh naun!
Pikin dey fall from sky?
No bi foetus dey form am?
I keep quite.
Na Doctor dey save lives oh!
My papa injure from war
Doctor say him too loose blood
Say the wounds too much
Say na vegetable him go come be
E better him kpai
Na im him gian coup de grâce.
My mama dey sick
Doctor no tok say no hope ooh
But him say na mercy killing
go better for her.
Now, inside my body dey sick me
Cold for outside, inside dey heat me
My eyes dey see double
I don near the other side
But i no wan cross,
I don chop mericin tire
Now, dem dey carry me go see Doctor
Doctor wey dey save lives
As na me come say involve now
I no go like that kind life saving
I know say him must save my life
But i no wan die now!

-Okoemu Okoemu Okoemu, The Enlightened One

COMMENTS OF THE POEM
READ THIS POEM IN OTHER LANGUAGES
Close
Error Success