You For No Poem by Atsu Adaletey

You For No



You for no
Say I dey shine my eyez
Coz na so so wahalla wey dey shine for my head top

You for no
Say na I jos dey parade my gari den granot
So sey hunger no go kill me now
Coz if I die now, I just don die for oyibo land

You for no
Say na my papa den mama na won make I travel som
Make dem dey see me to as Bossu
So dem go fit carry dem fugu den celebrate my dollar

You for no
Na me to I for get swag
Make I fit dey speak like oyibo
Make smoke dey commot for my mouth abi

Ha! You for no
Make I don coat
Den take serfee den post post for my facebook
Make my neighbors nor say me to I dey

You for no
Na make me too I don grab oyibo girl-y
Make I don get chwingorm kiss-y
Make I don do the tin-y
Make she don get belly bigg-y
Make my pikins get oyibo skin-y
Make dem talk like dem dey sing-y
Hahahahahaha you for no
Say me to I do sorm
Say me too I dey


Bot
If I die



You for no say
Ibi my stupidity wey kill me



So you for no.

COMMENTS OF THE POEM
READ THIS POEM IN OTHER LANGUAGES
Atsu Adaletey

Atsu Adaletey

Accra, Ghana
Close
Error Success