Abeg waitin dey se le!
Why u let sadness
Cast ha shade for your face
Wey sun dey look for place
Bcos say u neva see chop
Abeg no fear
Na only u waka commmme
Abi you never hear
Diaris godoooo!
Nose no die
Nose no rorti
Nose no kpeme
Nose go breathe.
No let igbudu monki
See u make he loose hope
Forget the tori
Wey make u nor dey cope
Bcos say u neva get owho
Bcos say u neva buy four leg
Abi bcos say u neva build your obi
Abeg no fear
Na only u waka commmme
Abi you never hear
Diaris godoooo!
Nose no die
Nose no rorti
Nose no kpeme
Nose go breathe.
This poem has not been translated into any other language yet.
I would like to translate this poem