Our Lords Prayer In Pidgin Prose Poem by Tony Ogunlowo

Our Lords Prayer In Pidgin Prose



Our Fadda
wey dey up in di sky
for heaven,
as I dey for dis life
na im
I go be for heaven
as I dey go waka
everi day,
help me find
wetin I go chop
and forgive
me for all di bad ting
wey I do
as I forgive dem
dat do bad for me
and tink bad for me
push me
to waka away
from di ting
that go cause me wahala
and no let
di devil
make me do bad tings.

Na you be di God
wey get powa pass everi ting
wey you take
look after us
now and for eva.

POET'S NOTES ABOUT THE POEM
Another take on Our Lords Prayer from my collection 'Monkey Dey Suffer and Poem Dem'
COMMENTS OF THE POEM
READ THIS POEM IN OTHER LANGUAGES
Close
Error Success