Why Make Him Wait? Poem by Emmanuel Edafe

Why Make Him Wait?



I've been thinking of the thin line between love and hate..😒
And how it's so hard for some to cross even with a bait
How each day breathes seeking for a sincere mate
And we all posses the earth with different fates
With relish running round retro race..

It's amusing many still question the belief in a God
Mr Doubt questions if there's truly a supreme being up above
Who has fashioned the earth without gloves✨
And created us with an emptiness only he can fill
Loving us more than we can love

The dawning of reasoning spoke..
But obi na hustler wen no send
Ada na sabi girl wen no dey pretend
If you think say you sabi spend
Come meet Oga Micheal you go bend
But Men!
Their life no really complete oo
Why make him wait?

But anytime I ball in with my rabbas
Tables dey turn..
Niggas dey no say boss don come
Babes dey feel am say na me be 'don'
Even hype man dey wan show say ein be better bike man..
But still on still.. I no dey feel complete
Why make him wait?

Me my presence dey kill
I dey give men chills
Their eyes sef dey peel
I be Queen on the hills
Omotosho wen sweet pass Calabar meal!
But still on still.. I no dey feel complete
Why make him wait?

Pesin no dey live this life twice oo
I go like play my own part like dice oo
My face must show I no go be like mice oo
My shoe must shine and ein go fine pass rice oo
But Aunty Racheal na model..
Still her life get comma..
Why make him wait?

Shebi I dey go church..
Na me dey give pastor lunch
I be Jesus first born
Make I still dey do my doings..
Ein go understand..Na matter of chillings
Kai! But I no dey feel complete oo..
Why make him wait?

Answers to these questions I sook..
Staring at me in the face was the reality of the human nature wanting to be free and unwind..
But there remains this place in us that nothing fills except love that truly binds..

Learning has brought it to us..
Seeing has brought it to us..
Hearing has brought it to us..
Experiencing has brought it to us..
Still his love remains knocking at our doorstep
Saying I want to be your plus..
Why make him wait?

Today he cries out once again..
Come to me and I will give you rest🙏
Please don't make him wait..

🙏❣️🙏.

Saturday, July 1, 2023
Topic(s) of this poem: seeking
POET'S NOTES ABOUT THE POEM
A burden in my heart
COMMENTS OF THE POEM
READ THIS POEM IN OTHER LANGUAGES
Close
Error Success