Make You No Enter One Chance Poem by Raimi Babatunde

Make You No Enter One Chance



This no be joke oh!
You dey travel today?
Your transport don complete?
Enter park straight oh
Boys are not smiling oh!
Make you no enter once chance

Ayys, wey you?
You dey pass Kogi?
Abi na Lokoja, Abuja road
You see all the road wey enter there
Na hotspots oh! I don yarn finish
What of Zuba, abi Osun road?

You dey find work abi
Congratulations my friend
You see those handbills, flyers
White chalk vacancies so
Wey you see for walls
Most na traps for kidnapping and 410 oh!

If you call the phone number "peren"
"Ti e ba e", na "Alo rami rami" bi that oh
Na do as I say specialists be that
No call them oh!
Except you don finish your assignment
Masters of hypnosis, na dem!


What of for Lasgidi
When you reach Ikorodu, Festac
Iba, Oshodi, Mushin receive sense
Organ harvesters dey street now oh!
For them, all hustle na hustle
But one day one day, hand go touch dem

Madam Slay Queen
"Maaaamoo oh", fine gal no pimples
You want i-phone 30 abi
You leave your caban follow man
Na your Mama I pity for
Dem go just use your thing for Yahoo plus

When your driver and conductor start code
Dem start use Pure water, coconut
Goats, Ice block for interstate route
And dem dem dey for phone oh!
Na bye bye be that oh!
Na you dem dey describe so

Before you know
The motor go break down
Usually, for middle of nowhere
Another chariot go come
Na heaven straight be that oh!
If you no hold your God strong
Make you just dey sing "This world is not my own"

No be everybody wey mad dey craze
Dem get money pass you
Na their 411 be that oh
Especially when you pass black spot
Just ready to gbez, fante sharp sharp
If you see person wey dey mental

Your car break down for night
Around drains, canal, bridges
You wan repair car
Oya, on your mark, set!
Na missing person things be that oh
Run for your life
Insurance go pay of na comprehensive

You dey do Ijebu for motor
You dey do rush rush
You be good candidate for kidnapping
Plan your work and work your plan
Me, I can shout oh!
Na why I dey clear you like this

You see shekels for ground
You say "Oluwa" don answer your call
Abi your ancestors don bless you
Na Baba place you go appear
Abeg, jump and pass
Make you go hustle

You like brokoto, inu eran
Kpomo, shaki and edo
Na every party you dey go
Weldone! Onije kuje
No be all party be party oh
As you dey bite the meat so
Na "kporkior", you eat so
Na so dem dey take your destiny

Madam Escort Service
You know wetin I dey yarn now!
Na so, the thing dey start
From clap, den enter dance
If you wan die, abeg die alone
No involve our student for your parole

Make I come carry my two left leg
Make I piaun sharp sharp
Before you go see me as talknoris
The one wey I fit do
Na him I don do so
Person wey get ear
Make he hear...

Tuesday, November 26, 2019
Topic(s) of this poem: motivation
COMMENTS OF THE POEM
Kingsley Egbukole 26 November 2019

Very wise advice on the unfortunate happenings in our country. Nice one.

0 0 Reply
READ THIS POEM IN OTHER LANGUAGES
Close
Error Success