Habba! Poem by Joel Abbas Wayarda

Habba!



Haaba!
"She bi wowo,
And she go join ashawo.
Shem, she no preserve for ha sef;
Who no weda she get AIDS sef."
HAABA!

Fine! We no approve wetin she dey do,
But why dey judge and condemn wetin she dey do?
Chek her profile, you go no say, na condition wey make crayfish bend;
But God had mercy on you, you no even get poverty to lend.
HAABA!

She never one dey beg or insult you,
She just dey mind ha business wey no consan you.
You neva give am shi-shi pay her bills;
So why dey run your mouth spoil her deals?
HAABA!

Even Baba God, say make We no judge,
So na you holy pass, His punishment you won dodge?
Abeg can We just mind our shop,
And empathize with people wey no get food chop?
HAABA!

Rather than gossip, calling God's Creation name
Lets focus on our life bringing glory to His Name
Then We will learn to love God's creations, irrespective of their faith
Because las-las, na God's Mercy, He alone our life can rate.
HAABA!

Wayardas-Pen

COMMENTS OF THE POEM
Chinedu Dike 31 December 2021

Dis poem make plenty sense, and me I enjoy am well well. Omo carry go.

0 0 Reply
READ THIS POEM IN OTHER LANGUAGES
Close
Error Success