Night Bus... Poem by Raimi Babatunde

Night Bus...

Rating: 5.0


Chai! Night bus
I die there
If I hear say I no do night
With all the jollyment
Men! You dey miss
Na night dey Sweet pass
Who day help?

If you run Lagos to Abuja
Abi Calabar to Lagos
No dulling for night bus oh!
Just hold enough shekels
When you sight the Chorry
Na to dey buy, dey buy
Na there the journey begin

You go see fine fine gals
The ones wey go burst your skeroo
When movement don set
Just start to dey scatter talk
When she laugh
The shenkiz go just dey matrix
The thing don set be that

When time to crash come
Just tell am to relax
Head for your lap things
If na shenkiz wey soji
Na one way ticket be that
From there, just dey do magic
Na make your hand dey enjoy

If the Chorry wan form Vandame
Just tell am make she kpomkpi
Just start from the periphery
Come work your way in
Na small small oh!
Remember, na from clap dem dey take enter dance
No say I no clear you oh

If you never travel night things
Men, you dey miss plenty things
All die na die oh
Na one thing go kill a man
But that night bus own
Na there heaven finish
Oya, "Gbe body"

Saturday, September 21, 2019
Topic(s) of this poem: love
COMMENTS OF THE POEM
Kingsley Egbukole 21 September 2019

Your opinion though. Night bus is a no go area for me except on emergency. Good poem. Kingsley Egbukole

0 0 Reply
READ THIS POEM IN OTHER LANGUAGES
Close
Error Success