Leave Am For God Poem by Frank Adie

Leave Am For God

Rating: 5.0


Nothing pass Baba God,
No allow anytin make you sad,
Nothing dey this world,
Kpata-kpata we all na sand.

Hunger go only fit waya you,
But e no fit kill you,
Even na garri with kernel you dey soak,
Baba God still get your back.

No condition is permanent,
Baba God na him be dey Omnipotent,
No mata how life suffer you,
Him go still dey protect you.

People wey do you bad,
Make you leave dem for God hand,
Ninety nine days na for the thief,
So make you no worri yourself.

Person weh bend down dey look your yash,
Him don follow expose him own yash,
So no carry anybody for mind,
Leave everything for God hand.

Tuesday, December 19, 2017
Topic(s) of this poem: life
COMMENTS OF THE POEM
Chinedu Dike 05 January 2018

Writing for the edification and glorification of The Lord Almighty is the hallmark of ingenuity. Thanks for sharing Frank and remain blessed.

0 0 Reply
READ THIS POEM IN OTHER LANGUAGES
Close
Error Success