Mek-Up Poem by Ekwueme Kelechi

Mek-Up



Na you go mek wimen mis heven
Hau you tink se you go mek am
Wia you cari fes
Wey no bi dia own giv dem?

You no no se
Na dia ril fes
Wey dey baba God camera
Dis wan you giv dem

Fit mek am
Pas dia nems for heven buk
You de mek dem luk
Laik doz Angels God posu

Bifor from heven
In go tink se dey come bak

(c)EKWUEME KC

Thursday, June 7, 2018
Topic(s) of this poem: satire
COMMENTS OF THE POEM
READ THIS POEM IN OTHER LANGUAGES
Close
Error Success